Value Edo film '' artists pipo or''¦
 
Nigerian Observer  Apr 26, 2024      
 
 

By

April 26, 2024

Anoda day don land again and no be mou moi say all of us gada see today and to even still cum fit de togeda to celebrate today. De rison be say, nor be everi bodi wey follow us see las wik cum fit see today. Dis na baba God handiwork na, in it?

Plenti tins de for awa kontri wey fit make man pikin kpai before him time, but baba God wey stand for us gidigba cum giv us de power to take nor gree for anybodi. If you no, you no, but if de tins of life don drive rough for ya side laik awa tuketuke wey nor de get break but de hustle for passenger for main road, you must to undastand say, dis life na beta jungle and to survive am, person need to get cross heart laik deaf and dumb wey don make up him mind to drive katapila to budose person wey vex am hax.

How many of us don see say, Edo don de bubble since with film production, music, foto and visual artists pipo? Infact, as de mata take de so, oda states de jelosy us over say we de too enjoy as awa gofment don pour plenti kuza yanfuyanfu for inside awa bizness.

If you tink say na lie, make you go check how many film pipo de cum Benin cum video dia films, abi na all de plenti musishan wey dia show de take place for Benin? Wat about all dose pipo wey de mode, draw pipo plus plenti plenti tins? Abi na de profeshona foto pipo wey de take foto for gofment for inside, Edo and outside Edo? My pipo, de list too long ooooo!!! To even shock una laik naked wire, many more go still shele for awa state wey we neva even see. Una even no say gofment de build intanashona film studio for near moat wey face creative hub for back gate? If una nor no now, una fit nor no again ooooo!!!

Awa Edo State gofment don Wellemly try for all de tins wen dem don do for artists pipo. Infact, na dis Kain tin dem don do, naim de make person rememba dat shush song wey de saykant ya blessings, name dem one by one, kant ya blessings name dem one by one, kant ya blessings name dem one by one, and e go surprise you wetin God don do. True true, if una use adult eyes take luk all de tins awa gif me t don do for awa state, e reach wey all artists and film pipo go take de shout gboza to awa gofment any time and any wia dem see dem, but de pipo wey de very happi and don benefit from de gofment to de shout all dis plenti gbozas nor de stay or liv inside Edo State, and e get why, but you for nor undastand.

Many foto pipo plus film and music pipo de komplain say, all dis plentiful goodies nor de reach dia hand as na pipo from Lagos and oda states de enjoy am. Tatafo gada from many of dem say gofment de laik to bring pipo form Lagos and oda states, and baff dem with kuza to de do dem work for hia but de home base go just de luk laik lukozed. Musishans for hia still de wonder why dem do de hia and gofment de celebrate Lagos and oda state musishans, wiaras for all dis pipo states so, dem no de send non native and nor go ever gree make dia gofment liv dem go de carri artists from oda states for head. Dis no be to show say tribalism good oooo!, but if go helep grow and to boost local production, dem na good tin for de time being. E shock una? Una go learn new tin today as de mata de go so, in it?

From wetin l don no and see for awa state, we de always be numba one for anytin even wen we be Bendel, na de same tin. We nor de carry las for anytin but why we cum begin de carry las for wia we suppose carry first? Why we de do de opposite tins for wetin konsan film, music, foto, visual artists, cultural group, comedians and odas dem? Wetin even make de tin de tire pipo be say all de pipo from oda states go pack all dem actors cum, giv dem all de bata parts and cum de giv parts wey no go fit sell or make awa actors popular. Na how we wan cum take grow awa industry if gofment no wear dem cap wey get value plus honor? Anyways, no be say dis pipo nor go still fit survive laik dem don de survive since, de k-leg inside be say, na gofment for fit quick make de road for dia bizness clear wella, but wetin dem fit do apart to konplain laik dis?

Tatafo even don cum hia say, de film editing studio wey gofment de build for film pipo nor go de dia kontrol but for pipo from oda states to cum de in charge why de film pipo wey dey de state go cum be stranger and visitor to dem own property, who does dat? according to late Jnr Pope. Dis mata l de yan so, fit not make sense to plenti of us laik many tins no de make sense, but if we still get any teeth for mouth, make we begin use awa tongue begin kant dem, e get why. Wen landlord agree to becum tenant for hax wey him build, naim be say jazz don achieve am be dat. If true true gofment really wan grow awa creative industry plus de pipo wey de do and keep de bizness from dose days till today, gofment must with clear eyes and mind luk dem side and true true make dem landlord of dem own hax for dem land dan to make dem konfuse tenants inside dem own hax. If we grab de message no wahala. If we nor still grab de message, wahala not go still de as life nor go off till wen messiah go cum to de Edo artists problems and to make dem de reap de fruits of dem labour. Me l no say, las las, water go find him level. Until den, make l waka small to find wia l go hia anoda tori to nak una nex wik. I salute awa courage as a pipo.

By

April 28, 2024

By

April 28, 2024

By

April 27, 2024

April 27, 2024 at 10:12 PM

March 12, 2024 at 09:21 AM

The Nigerian Observer is a daily newspaper published in Benin City, Edo State, Nigeria, since 1968 by the Bendel Newspapers Company Limited (BNCL) and is owned by the Edo State Government

Subscribe our newsletter for latest world news. Let''s stay updated!

© 2024 Nigerian Observer “ All Right Reserved.

 
Visit News Source
Related Stories
 
 







   
   
 
 
 
 
Web Services Software Products Business Solutions Tech. Services Insight
   
               
© Plucom Technology Ltd.  Nigeria. All right reserved.